April 14, 2015

We don Land Again with Awoooof Credit for all of una wey the kolombi for our blog...


You don hear watin the shelle for this blog at all???
E better say you hear this amebo two times than say you no hear at all...
no time to begin speak plenty plenty oyibo grammer......

BurningSuccessBlog don land gidigwa for we obodo nigeria with freee recharge card for all them blog readers ....Make you no for carry last, na him make we the yan give una this recharge card awooof amebo!

Watin you go do be say, just the visit www.burningsuccessblog.com every time to hear the whole amebo we the pass for we country whether na politics oo, entertainment, sport abi na tips on how man pikin fit get small small money online...

Then, make you quick check our blog every friday by 1:00 for afternoon to collect your own share of the awooof recharge card...  We go just blow the recharge pin throway for the blog.... na fastest finger na him go shop pass be that ooo...

No do yourself ooo.... as for me, i don hold myphone for hand, just tanda the wait for friday....


We go post the recharge card pin and then post the colour of them makers... Red card mean say na AIRTEL, Yellow Card mean say na MTN, then GREEN Card mean say na GLO... Etisalat never include sha.


Abeg my people, the only favour wey we the look for be say, make una no tire... make una the share torry about our blog give all una friends and family members.... As we the get una for mind, make una too the carry our matter for una head. Nigeria don better be that. Una fit reach us for twitter and follow us. Our twitter handle na www.twitter.com/geoffreyobi Or Una fit track us for facebook and follow us too. Our facebook address na www.facebook.com/burningsuccess


THIS PROMO na for only people wey dey insdide Nigeria oo!


Fellow Nigerians, Let the SUCCESS Burn YOU …!
Proudly sponsored by: MTN, GLO, Airtel  and Indomie Noodles.

No comments:

Post a Comment

THANKS FOR VISITING.
YOUR COMMENT(S) WILL BE APPRECIATED.
CONTACT Geoffrey Johnson Obi for News Tip Off, Music Promo, Adverts on 08166115804 (phone calls or whatsapp) geoffreyobi92@yahoo.com or geoffreyobi92@gmail.com